Tori of coup plot for Nigeria na lie – Defence Headquarters

February 26, 2024

Nigeria Defence Headquarters don hala say tori wey dey spread round say high alert don dey sake of coup plot for Nigeria na lie.

Di fake tori bin add say di suspicion na im make dem call emergency meeting wey President Bola Tinubu bin dey inside.

Oda pipo wey dem allege say bin dey di meeting na di chief of staff to di President and di Commander of di Guards Brigade.

For statement wey dem release on Monday, dem reveal say di tori wey comot on Sunday say, “di Guards Brigade don dey put on high alert on top unusual movement wey cause suspicion of coup plot for Nigeria”, Brigadier General Tukur Gusau, acting Director Defence Information tok for statement e sign on Monday.

Defence Headquarters add say dem “wish to categorically state say di allegation dey false.”

Dem explain say di Guard Brigade work na to protect di seat of power wey be di Presidency.

Becos of dat work, dem dey also protect di Federal Capital Territory so dem always dey on high alert.

Defence Headquarters also don comot to say dem go go court on top di pipo wey face di fake tori.

Dem say na because do pipo bin do am to create unnecessary tension for di kontri.

Already, Chief of Defence, General Christopher Musa don come out on different times to clear pipo on how members of di armed forces tanda gidigba on top di protection of Nigeria.

For West Africa, na three different kontris currently dey under military occupation, Burkina Faso, Mali and Niger.