Tinubu dey celebrate chess master Tunde Onakoya new world record

April 22, 2024

President Bola Tinubu don hail Tunde Onakoya for im new world chess record and for projecting Nigeria’s resilience, self-belief, and ingenuity for global recognition.

According to one statement from im media aide, Ajuri Ngelale, Onakoya break di Guinness World Record for di longest chess marathon on Saturday, afta e play for over 58 hours and win every match.

Im yarn say di President celebrate di Nigerian Chess Champion and founder of Chess in Slums Africa for dis rare feat, wey dey also raise funds for African pikin to learn and find opportunity through chess.

Ngelale talk say di President don assure all citizens say im government still dey committed to creating and expanding opportunities for di youth to explore and exercise their abilities, and become di symbols of greatness wey our nation represent into di future.