Police authorities confam train attack for Edo

January 9, 2023

Police authorities confam say jaguda pipo attack train station for Edo state, kidnap passengers wey dey wait to board train.

Di attack happun for Igueben station for Igueben Local Government Area of Edo State.

Tok-tok pesin of di State Police Command, Chidi Nwabuzor, wey confam di incident give BBC say di assault happun on Saturday evening and many pipo injure.

According to di Police, di abductors, wey cari AK 47, invade di train station and shoot sporadically into di air before dem abduct scores of intending travellers, cari dem enta bush.

For statement wey dem bin earlier release,  police say many of di passengers sustain bullet wounds.

Dem also tell Nigerians say dia officers don begin find di abductors and dem plan to rescue di kidnapped victims.

β€œOn 7th of January, 2023, at about 1600hrs, unspecified number of herdsmen wey cari AK 47 riffles attack di train station for Igueben, Edo State, and kidnap unspecified number of passengers, wey bin dey wait to board di train to Warri.

β€œDi kidnappers, wey shoot into di air before dem kidnap some passengers, leave some pesins wit bullet wounds.

β€œDi Area Commander Irrua, DPO Igueben Division and men, don visit di scene of di crime wit members of di Edo State Security Network, local vigilantees, and hunters wit view to protect di lives and property of di remaining passengers,” di statement tok.

According to Oga Nwabuzor, dem don begin operation immediately to rescue di victims and arrest di kidnapers. Local media say na upto 32 pipo di kidnappers cari but dis figure no dey confirmed yet. Dis attack dey come just nearly one year afta bandits attack one train wey dey