Oscar Pistorius don get parole for South Africa nearly 11 years afta im kill im girlfriend

January 5, 2024

Dem don release ex-Paralympian, Oscar Pistorius on parole from one South African jail, nearly 11 years afta e murder im girlfriend Reeva Steenkamp.

E shoot her multiple times through one bathroom door for 2013, e later tok say im mistake her for tiff.

Dem convict Pistorius, wey be 37 years old now of murder for 2015 afta one appeal court bin reverse one earlier verdict of culpable homicide.

E go live under strict conditions until im sentence expire for 2029.

Under South African law, all offenders dey entitled to dey considered for parole once dem don serve half dia total sentence. Dem set Pistorius parole for 2017 at 13 years and five months.