Ghana govment don deny say dem collect money from Donald Trump sake of deported West African migrants
Dis one follow lawsuit wey accuse U.S. say dem tie deportees for straightjacket, give dem only bread and water for 16-hour flight before dem land Ghana.
Foreign Affairs Minister, Samuel Okudzeto Ablakwa, tok say Ghana no collect one dollar from America. E say dem only accept di deportees as humanitarian gesture because dem be West Africans.
Di lawsuit target na di Trump administration, no be Ghana.
Earlier, Ghana president John Mahama bin confam arrival of West African deportees wey come from di United States afta both kontris reach agreement.
President Mahama on Wednesday 11 September 2025, tok say about 14 individuals wey di US bin deport bin land for Ghana.
Dis don raise plenti tok tok from pipo including Ghanaians wey dey ask weda di govment collect money from di US in exchange for di deportees.