England Under-21s don qualify for their first European Championship final since 2009.

July 7, 2023

Di Young Lions, wey never concede any goal for di tournament, don qualify afta dem win Israel 3-0. England bin don beat Israel 2-0 for di group stage of di competition before.

Di English youngsters go play against Spain for di final wey go happun on Saturday, as dem dey aim to win di competition for di first time since 1984.