Governor Francis Ogbonna Nwifuru don yan say from 2026, house and land agents no go fit operate again for Ebonyi State. Di move na to stop di high rent wahala wey dey choke residents.
According to di Governor, plenty agents dey use style chop people money — some dey collect as much as ₦500,000 for houses and lands wey no even belong to dem.
From next year, dem no go allow agents collect shishi from anybody wey dey find accommodation for di state.