Church discover say Female chorister na man after ‘her’ death for Port Harcourt

February 7, 2023

Members of St. John’s Catholic Church Rumuolumeni for Iwofe, Port Harcourt, Rivers State, southern Nigeria dey in shock afta dem discover say di pesin wey dem know as Emmanuella Adaolisa, a choir member for di parish na transgender woman wey bin dey registered as man wen dem born am.

Mortuary attendants reveal am wen dem wan begin work on di deadibodi wey di catechist and some members of di church bin come deposit as a woman, only to discover say na trans woman.

According to tori, Emmanuella Adaolisa na pharmacist wey graduate for di University of Port Harcourt and dey identify as a trans-woman.

But members of her local church bin no know.

On 31 January 2023, afta di evening programme of di church, on her way home, Emmanuella get accident as she fall out of di keke napep tricycle wey she enta, fall inside gutter.

She come dey bleed especially all around her face. Na only she die for dat accident.

Afta sometime, information reach di church choir members say one of dia members get accident so dem and di Catechist rush go dia and rush her go hospital.

Di first hospital reject her so dem carry her go Military Hospital along Aba road wia dem confam her dead on arrival (DOA).

So dem carry her go di mortuary wia di mortuary attendants come discover say she be trans woman.