binance

Binance say dem go stop all service wey dem dey provide for di Nigeria Naira Service

March 6, 2024

The cryptocurrency exchange company say, from di 8 of March all di Naira service wey e dey provide for Nigeria crypto traders go stop.

For statement wey di exchange post for dia platform, e say: “Binance go remove NGN from di list of supported payment options on Binance Pay.”

Di announcement come afta Nigerian goment block access to di platform for February on top accuse of plenty mago-mago.

Di goment say di cryptocurrency platform dey make di kontri lose plenty money becos dem dey fix exchange rate.