NEMA don confirm at least three pipo dead and several pipo wonjure as one moving train jam one Lagos State goment bus for PWD bus stop for di Ikeja area of Lagos on Thursday morning.
Di southwest zonal coordinator of di National Emergency Management Agency (NEMA) Ibrahim Farinloye wey bin earlier put di figure as two confirm to tori pipo say di death toll don rise to three.
“Two adult females staff of di State Government wey die and several wey dey injured don dey evacuated,” im bin tok earlier.
Current death toll na two adult female and one male, according to Farinloye.
“Di State goment staff bin dey try cross di PWD/Sogunle rail crossing while di train wey dey come into Lagos from Abeokuta trap di bus ontop rail,” e add.