You suppose arrest Wike – Clark tell Police IG.

September 5, 2024

Chief Edwin Clark, wey be di leader of di Ijaw people, don call on Inspector General of Police Kayode Egbetokun make dem arrest Nyesom Wike, di Minister of FCT. Dis one follow as Wike tok say im go burn di states wey PDP governors dey control.

For PDP state congress wey happun for Saturday, Wike warn di governors of di party make dem no put mouth for di party matter for Rivers state. Wike tok dis one for di party secretariat for Port Harcourt, di state capital.

For one press conference wey happun on Thursday, Clark yarn say di Minister words na “big insult to President Bola Tinubu, wey appoint am,” and e describe Wike tok as “uncontrolled” because e fit cause wahala and bloodshed for di kontri.

Clark also talk say, dem arrest #EndBadGovernance protesters and African Action Congress presidential candidate, Omoyele Sowore for dis kind mata before, so e wan make di Inspector General of Police (IGP) do di same thing to Wike, and make im comot im words.