Yellow bus drivers for Lagos go boycott work from TODAY (MONDAY) – Dis na why

October 31, 2022

Commercial drivers for Lagos State don warn say dem dey go on seven days protest and boycott of services across di state.

Na sake of allegations of plenty extortion by di management of parks and garages wey dey inside di south west state for Nigeria.

Di Joint Drivers’ Welfare Association of Nigeria (JDWAN) tok am for one press statement dem release ova di weekend.

“We dey saddened say despite our dedication to our work, we dey subjected to indiscriminate extortion, violent harassment by di management.”, JDWAN tok.

Di National Leader of di association, Comrade Akintade Abiodun say di multiple levies on di joint drivers by di garage boys and law enforcement agents don cause increase in di prices of food items for Lagos compared wit oda states, as garage boys wey mount road blocks on Lagos road dey put plenty money on consignments wey dey enta di state.