Wetin we take $1billion recovered loot do’, Nigeria goment

November 24, 2022

Nigeria Goment say dem don recover one billion dollars ($1,000,000,000) since President Muhammadu Buhari administration start from May 2015 till date.

Attorney General of di Federation and Minister of Justice, Abubakar Malami tok on Wednesday afta di Federal Executive Council (FEC) meeting.

Na president Buhari preside ova di meeting for State House, Abuja.

“One of di pillars wey President Muhammadu Buhari goment stand onttop na di fight against corruption and oda tins,” e tok.

Sake of dis, im declare say di Council don approve one anti-corruption strategy document wey go strengthen anti-graft fight for di kontri.

Di Attorney General of di Federation explain say goment dey worry about di recurrent cases of budget padding, and dem go find strong way to tackle am.