Wetin dey different about ‘newly redesigned’ naira notes Buhari unveil?

November 23, 2022

President Muhammadu Buhari today 23 November 2022 unveil di redesigned naira notes for State House Abuja.

Di President during di ceremony explain say di new notes go help di kontri address di issue of illegal financial flows, corruption, improve di nation economy, as well as ensure advancement in di value of di naira.

Di new 1,000, 500 and 200 naira notes get same resemblance wit di old one but e get distinct difference in di colour.

For di ceremony wey take place during di Federal Executive Council meeting, CBN governor Godwin Emefiele claim say di redesigned currency note “no go ever fit dey counterfeited”.

Im add say to stop such occurrence, CBN go redesign di notes after every five to eight years.

Wit dis new designs, Emefiele say heavy restrictions go dey on di volume of cash wey pipo fit withdraw over di counter, as di CBN go work wit Nigeria corruption police – di Economic and Financial Crimes Commission – to monitor di purpose of any heavy transactions.