Defense chiefs of West Africa don propose one plan to deploy a 5,000-strong “standby force” to fight di region’s worsening security crises.
Di plan, wey go cost $2.6 billion every year, dem propose am to heads of state for one meeting of defense officials today for Nigeria capital, Abuja.
E also aim to prevent further coups after di string of military takeovers wey don destabilize di region.
As e dey address newsmen, President of di regional bloc of ECOWAS Commission, Omar Touray, urge member-states to support di force.
For more news https://naija927.com/ph/news/