” We Win and I go Use Every Legal Means to Collect Our Mandate” – Peter Obi tok as him Address Supporters

March 2, 2023

The Labour Party Presidential Candidate for the 2023 Presidential elections wey just finish, Mr Peter Obi, don vow say as obedient person wey him be, him go enter court go reclaim him mandate just as the INEC commissioner advice.

Obi say him no go ask any international observer about the election. Say na Naija mata and na Nigerians him dey listen to.

Peter Obi also beg people say make dem Come out come vote for the (March 11) governorship election. He say na we wetin the cabals want, say dem want make pipo tire.