‘We dey track pipo wey dey sell new naira notes’

January 31, 2023

Afta di Central Bank of Nigeria announce di extention date for di exchange of old naira notes to new, many pipo don begin ask kwesion on top social media about how di 10 days go fit benefit dem.

Oga of di Apex bank Godwin Emefiele wen e go brief president Muhammadu Buhari on Sunday evening about how di programme don waka explain to tori pipo why gomment decide to redesign some currency.

E say di CBN neva get di opportunity to redesign di naira since di past 19 years.

Emefiele say na only pesin wey no dey corrupt like president Buhari fit give dat kind approval