UNLAWFUL ARREST; ONE MECHANIC DON ACCUSE OGA ON TOP RIVERS STATE TASK FORCE ON WASTE DISPOSAL

October 27, 2022

Dem don sama accuse give di oga dem inside Rivers state taskforce on waste management wey their leader na Jack, because say im arrest three motor mechanics opposite Zilly Agreey street for chinda, mile 4 inside port Harcourt for one offence wey dem no gree talk plus still collect twenty thousand naira from dem.

One of di mechanics, Sunday Akarabara, wey talk say im never get shop for roadside before, come yarn how dem take arrest am go keep for inside RIWAMA cell for six hours without any offence and im still follow pay dis 20k.

The taskforce management never come out come cough on top dis matter. But sha, di National Legal Adviser of Centre for Basic Right Protection and Accountability Campaign, Joel Victor, don call for torch highlighting on top dis matter plus immediate arrest of people wey dem find guilty.