UK Court find Senator Ekweremadu, im wife and Doctor guilty of organ-trafficking

March 23, 2023

Uk court don find Nigerian Senator Ike Ekweremadu and im wife plus one medical “middleman” guilty of one organ-trafficking plot, wey involve one 21-year-old man wey dem carry come UK.

Dem find di 60-year-old senator and im wife Beatrice, 56, and Dr Obinna Obeta wey be 50-year-old dey convicted on top accuse say dem conspire to exploit di man for im kidney, in di first of such case under modern slavery laws.

Di Old Bailey hear say di organ na for di couple daughter, Sonia, wey be 25-year-old.

Di court don clear her of di same charge.

Dem carry di victim wey be street trader for Lagos go UK last year to provide im kidney for inside one £80,000 private transplant for di Royal Free Hospital for London