Two die as E-Hailing Cab drivers suffer deadly attacks for Port Harcourt

October 13, 2023

Attacks on e-hailing riders don become source of concern for many pipo especially those wey dey operate for Rivers state, South South Nigeria.

Widow of Emmanuel Daniel, di e-hailing taxi driver wey passengers allegedly kill along Olu Obasanjo road for D/Line Port Harcourt dey cry for justice for di death of her husband.

Di widow, Eberechi Daniel wey be mama of dia three pikins say her husband just put tracker for di motor wey e dey use do di taxi but dem make mistake for di tracker so e go to correct am. On di way back e pick passengers.

Around 7pm na im pesin call her to come to Military hospital, later dem tell her to go Rivers State University Teaching Hospital.

“Wen I reach di hospital I ask wia my husband? Dem say dem go show me but after evritin, dem tell me say my husband don die, say armed robbers shoot am and collect di car but becos of di tracker, di car stop for road. Na di passengers wey im carry na im shoot am around D-line area.

Source – BBC