Better news don come out from Tunisia as court don finally release some NGO workers wey government bin accuse say dem dey help migrants enter and stay for the country illegally. The case don trend for long time and e don attract attention from inside Africa and outside.
According to reports from (Eye Witness ), the court on Monday grant the workers freedom after dem don spend close to two years for detention over charges wey human-rights groups describe as unfair and politically motivated.
One of the people wey regain freedom na Sherifa Riahi, former head of migrant-support group Terre d’Asile Tunisie. Videos wey dey circulate online show as supporters shout and jubilate outside court as dem come out free at last.
Reports say the accused — over 20 people, including NGO staff and local government workers — face serious allegations of “helping illegal migrants,” offences wey fit carry up to 10 years jail term. But rights groups argue say the people na only humanitarian workers wey dey give food, shelter, and medical help to migrants in need.
Amnesty International, for statement wey dem issue earlier and wey Reuters also report, condemn the arrests, call am crackdown on civil society, and warn say e go discourage people wey dey help vulnerable migrants.
Tunisia don dey under global spotlight in recent months as e be major transit route for African migrants wey dey try reach Europe, and several international media houses say the government don tighten hand on both migrants and organisations wey dey support dem.
As the freed workers waka out of prison, supporters dey hail the ruling as victory for human rights, even as questions still dey on how Tunisia go handle migrant and NGO matters for future



