Tinubu suspend minister of humanitarian affairs and poverty alleviation from office

January 8, 2024

President Bola Tinubu don order di immediate suspension of di Minister of Humanitarian Affairs and Poverty Alleviation, Dr Betta Edu, from office.

Di suspension dey inside statement wey Special Adviser to di President on Media and Publicity, Ajuri Ngelale sign on Monday.

Dis na sake of di ongoing tok-tok of corruption allegations wey surround di minister Betta Edu.

Ngelale say e dey line wit im commitment to uphold di highest standards of integrity, transparency, and accountability in di management of di commonwealth of Nigerians.

Di President further direct di Executive Chairman of di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) make dem conduct serious investigation into all aspects of di financial transactions wey involve di federal ministry of humanitarian affairs and poverty alleviation, and one or more agencies under am.