Supreme Court of Nigeria don reverse di CBN policy on new notes

March 3, 2023

Di apex court deliver di judgement afta dem bin adjourn di case wey challenge di federal goment implementation of di naira swap policy wey some state goments bring before am.

For di lead judgement by Justice Emmanuel Agim, court rule say di old 1000, 500 and 200 naira notes go run till 31 December, 2023.

Di court also add say “di cash limits no fit dey justified and di disobedience of court order by di president na sign of failure of our democracy.”

Di apex court hold say even though President Buhari get executive power im go against di constitution as im no consult di Federal Executive Council, di National Executive Council before im give di directiv