The Nigeria Football Federation (NFF) don confirm say the stranded Super Eagles players for Lagos and Abuja don arrive Uyo, the capital of Akwa Ibom.
The NFF Director of Communications, Ademola Olajire, talk say defenders Semi Ajayi, Bright Osayi-Samuel, Calvin Bassey, midfielder Frank Onyeka, and forward Paul Onuachu don already dey for the country and dem dey head to Uyo to join the 15 other players wey don already dey ground for the Super Eagles’ preparations for Friday’s 2026 FIFA World Cup qualifying match.
Make we remember say some of the Super Eagles players get wahala to join the rest of the team for camp because of the striking labour unions wey shutdown the country’s airports on Monday.
For more news https://naija927.com/ph/news/