Lamine Yamal don become di youngest goalscorer for European Championship history as Spain beat France 2-1 to reach di final of Euro 2024.

Spain don beat France to reach Euro 2024 final

July 10, 2024

Lamine Yamal don become di youngest goalscorer for European Championship history as Spain beat France 2-1 to reach di final of Euro 2024.

After Randal Kolo Muani head in Kylian Mbappe’s cross to give France early lead, Yamal curl home one correct strike from outside di box to write im name for di record books by scoring at di age of 16 years and 362 days.

Spain come dey ahead just four minutes later as Dani Olmo’s shot turn own goal by France defender Jules Kounde.

While Spain dey on course for their fourth European Championship title, dem go wait for either England or Netherlands wey go play today, ahead of Sunday final.

For more news https://naija927.com/ph/news/