Security chiefs meet for Akwa Ibom ahead of Saturday election

February 23, 2023

Di Interagency Committee on Election Security (ICES) meet for di headquarters of di Independent National Electoral Commission (INEC) for Akwa Ibom State, South-south Nigeria ahead of di presidential and National elections.

Di committee include INEC, di Nigeria Police Force, Department of State Services,National Intelligence Agency, Nigerian Correctional Service, and di Nigeria Immigration (NIS).

Odas include di National Drug Law Enforcement Agency, Nigeria Security and Civil Defence Corp, Nigerian Navy, and di National Youth Service Corps.

INEC tok-tok pesin for Akwa Ibom Odaro Aisien tell BBC Pidgin say dis na di third time di committee dey meet and na to finalise di preparation for di Saturday 25 election.

E say di state get 4,353 polling units and 2,357,418 registered voters.