SCHOOL TEACHERS PROTEST FOR THEIR 7 YEARS SALARIES WEY GOVMENT NEVER PAY

November 4, 2022

Teachers of Demonstration Secondary Schools inside Rivers State don talk say life no easy for dem at all, as dem never pay dem for seven years, despite say several court judgements don order di state govment to pay dem.

Two of dem, Chukwu Odinaka and Chris Ikunga, wey talk for one press briefing yesterday, say dem no fit provide for their families again and im come beg Govnor Wike to use di remaining five months of im administration to pay dem their salaries.

Chairman civil society organizations, Enefa Georgewill also join inside dis abeg because of how things don hard for di country.