RSU STUDENTS DO ‘’WE NO GO GREE’’ AGAINST ‘’NO FEE NO EXAM’’ PACKAGE

October 27, 2022

Students inside Rivers State University yesterday, waka enter streets of Port Harcourt to do ‘‘we no go gree’’ on top di NO FEE NO EXAM package wey di school carry come.

Di students wey gather for di school roundabout along mile 3, march go reach government house from ikwerre road. Even as police bin try to stop dem along ikwerre road, e no work.

Some of dem wey carry banner for head as dem dey do dis waka come follow our tori person, Allwell Ene, talk say dis package no sweet dem for body at all plus make di university management look into am with immediate alacrity.

Rivers state commissioner of police wey dey in charge of opertions, CP Ogechi, come follow di students tok say make dem no worry, im go look inside di matter.