Rivers NSCDC deploy 5,255 personnel for di 2023 General Elections

February 23, 2023

Rivers State Commandant of di Nigeria Security and Civil Defense Corps NSCDC, Michael Besong Ogar, say di Command dey ready to provide adequate security before, during and after di 2023 General Elections.

For Pre-Election Media briefing for di Command Headquarters of NSCDC in Port Harcourt; di Rivers State Commandant say di Command dey fully prepared for di Saturday 25 February and 11 March 2023 elections.

E say NSCDC dey apolitical, neutral and highly professional while on election duty.

E add say di training and re-training programs wey dem organize with INEC, Nigeria Police and oda Sister Security Agencies for di State get ogbonge impact so NSCDC officers and men dey well informed on election operational guidelines, di provisions of di electoral Act 2022 and NSCDC Standard Operating Procedures (SOP).

β€œIn line with di directive of di Commandant General Dr Ahmed Abubakar Audi mni OFR; di Rivers State Command don deploy 5,255 officers and men from di 23 local goment area, Departments and Units of di Command.