rivers-g-1536x1023

Rivers Gov’t Don Vex: Moves to Crush Child-Trafficking, Baby Factory Business & Illegal Surrogacy — As Big Media Raise Alarm

November 27, 2025

Rivers State goment don finally put leg for ground to scatter child-trafficking rings, close baby factories and clamp down on all those unregulated surrogacy wey don dey spread like wildfire.

According to reports wey don circulate , the state authorities say dem no go sit down dey watch criminals turn pikin-business to hustle. Dem don begin fresh operations to identify hotspots, raid suspicious clinics, and arrest anybody wey dey use women or babies take cash out.

Officials talk say the matter don reach breaking point, as illegal surrogacy houses dey operate without medical standard or government approval. Dem warn say anybody wey dey hide under “helping families” to run human-market go face heavy wahala.

Meanwhile, rights activistsdone praise the move, say e go reduce human exploitation and shine light for areas wey darkness don too thick.

For now, Rivers goment dey send strong message: “No more baby factories. No more pikin trafficking. Anyone wey no hear word go smell handcuff.”