Di 40-year-old, wey don score 953 goals for club and kontri, also say e go retire from football in “one or two years”.
Next year World Cup, wey go take place for Canada, Mexico and di United States, go be Ronaldo sixth.
For one interview at di Tourise Summit for Riyadh, wen dem ask am weda di 2026 go be im last World Cup, Ronaldo say: “Definitely, yes. I go be 41 years old and I tink [dis] go be di moment for di big competition.”
Ronaldo, wey dey play im club football for Saudi Arabia wit Al-Nassr, na di all-time leading men international goalscorer wit 143 goals – while e continue to pursue a milestone 1,000 career goals



