Popular Nigerian actor Bolanle Ninalowo say im don separate from im wife of many years Bunmi Ninalowo

September 1, 2023

Di Nollywood actor make di announcement on im official Instagram handle.

Di couple wey many pipo dey admire for social media get two children wey don grow.

Di ogbonge actor no tok wetin lead to dia separation for di long post wey e drop.

“Finally I accept di reality of di End to a Road… My wife & I don decide to go our separate ways and head for an irreconcilable marriage dissolution,” Ninalowo tok.