YERIMA

Police yarn say tori of assassination attempt on Lt. Yerima na pure lie!

November 17, 2025

ori wey fly up and down say some men inside two black Hilux wan assassinate one Nigerian Navy officer, Lt Ahmed Yerima, for Abuja, don turn out to be pure lie, according to di FCT Police Command.

Di police bin dismiss di gist early Monday morning, afta social media begin circulate story say unidentified men without number plates dey follow Yerima from NIPCO filling station for Kubwa Expressway reach Gado Nasco Way around 6:30 p.m.

According to wetin some local media carry, Yerima reportedly zoom comot with speed to escape di suspected attackers β€” but police don scatter dat gist.

Di FCT Police PRO, Josephine Adeh, yarn say no report of any assassination attempt dey anywhere