Police Gbab woman Wey pour hot oil ontop her husband while him dey sleep

October 13, 2023

The Rivers Police command don confam the arrest of one Hope Nwala wey carry hot vegetable oil pour her husband while him dey sleep for Obite Community in Okehi Etche LGA.

Police Public Relations Officer Grace Iringe-Koko tok say the middle aged lady dey undergo interrogations for the police command. 

Mrs Hope Nwala from Obite community had attacked her husband; Ekelediri Nwankwo in Okehi community in Etche Local government area with hot groundnut oil and hammer.

The victim Mr Ekelediri Nwankwo wey be middle aged man bin tell him wife younger sister to leave him house because of the way she she dey dress, and how she begin to occupy their matrimonial bed even when him dey around.

Him decision make him wife vex and the wife no gree make her younger sister go. 

Mr Ekelediri also narrate how him see him wife alone with one tall dark complexioned guy for the shop wey him rent for her where there two dey get deep conversation.

He add say him give him wife younger sista two thousand naira to take pay transport go back house. The thing no sit well with him wife and when him dey sleep, na him she carry hot oil pour am.