Police conclude autopsy on Mohbad as Nigerians turn up for candlelight procession to honour late singer

September 22, 2023

Di Nigeria Police say pathologists dem don complete di autopsy procedure ontop di deadi body of Ilerioluwa Oladimeji Aloba wey pipo know as Mohbad.

Informate from di Police for Thursday night tok say di result go soon dey ready and dem go make am public.

“Di Nigeria Police Force wish to inform di public say di autopsy procedure for Mr Mohbad don dey successfully completed,” police tok.

All dis dey happun as fans hold candlelight procession for Lekki area of Lagos, southwest Nigeria, to honour Mohbad.