Police arrest Sam Larry, One of di suspects for MohBad death

September 29, 2023

Di Lagos state police command say dem don arrest Balogun Olamilekan Eletu wey pipo know as Sam Larry.

Benjamin Hundeyin, tok-tok pesin of di police for Lagos confam di arrest on Thursday night.

Police bin don invite Sam Larry and artist Azeez Fashola alias Naira Marley for questioning over di death of Afrobeat star Ilerioluwa Aloba aka Mohbad.

Di names of di two pipo dey prominent among young pipo sake of dia initial relationship wit Mohbad.

Sam Larry and Naira Marley don dey consistent in dia position say dem no get hand for im death.