Pay ASUU members dia full salary’

November 7, 2022

Human rights lawyer Femi Falana, wey be senior advocate of Nigeria (SAN), don ask President Muhammadu Buhari say make dem pay members of di Academic Staff Union of Universities (ASUU) dia full salary.

DIs mata dey follow tori wey comot last week Thursday. say di federal goment bin pay lecturers half salary for di month of October.

Di lecturers bin say dem dey very disappointed in wetin di gomemt do.

Asuu bin call off dia eight-month strike on 14 October.

Olajide Oshundun, head of press and public relations, federal ministry of labour and employment, tok say di union members bin collect dia October salary pro-rata and not half salary wey tori pipo report.

“Dem do pro-rata was because you no fit pay dem for work wey dem no do…”

Falana wey also be ASUU legal representative, tok say di position of di goment dey “factually faulty and legally misleading”.