Organised Labour don propose N615000 as new Minimum Wage

April 15, 2024

Organised Labour don yan say dem dey demand N615,000 as di new minimum wage for workers to manage di many economic wahala and di high cost of living for Nigeria.

Di President of di Nigeria Labour Congress (NLC) wey confirm dis development yesterday, talk say di new wage of N615,000 per month na di result of consultations between NLC and di Trade Union Congress (TUC).

Federal Government bin inaugurate one 37-man Tripartite Committee with mandate to recommend new National Minimum Wage for di country.

Labour unions talk say di current minimum wage of N30,000 no fit dey enough to take care of di welfare of di average Nigerian worker again. Dem dey lament say no be all governors dey pay di current wage award wey go expire by April, five years afta di Minimum Wage Act of 2019 bin sign by former President Muhammadu Buhari.

Di Act suppose to dey reviewed every five years to meet up with di contemporary economic demands of workers.