Nigeria dey share di number three position among kontris for world and di number one for Africa, wey carry di highest number of pipo go di 28th Conference of Parties (COP28) conference for Dubai, United Arab Emirate (UAE).
Di host of di conference UAE, get di highest number of delegates wit 4,409 badges. Brazil follow for second position wit 3,081 and both China and Nigeria, get 1,411 badges.
Nigeria get more dan 1,400 delegates for Dubai wey go dia for period wey di kontri dey face very serious economic palava and dey battle high cost of living.
Dis don cause plenty reactions from Nigeria pipo and opposition groups.
One of di presidential candidate for di 2023 elections, Peter Obi, post for im social media platform say e dey sad say Nigeria dey send di same number of delegates wit China.
Obi compare China 2024 budget, Human Development Index, levels of multi-dimensional poverty and population as im argue say Nigeria get any business to dey send dat kain number of pipo.
On top of evri Obi say: “majority of pipo for Nigeria delegation to COP28 na non relevant civil servants or relations, friends and hangers-on of high goment officials. Most of dem no kuku understand or get anytin to di wit Climate Change.
Di opposition Peoples Democratic Party (PDP), also criticise di delegation saying na President Bola Ahmed Tinubu “friends, political followers and dia girlfriends” full di list “at huge expense to di kontri.”