Dem talk this one for letter wey NLC General Secretary, Emmanuel Ugboaja, send on Wednesday for Abuja to all affiliates and state councils. Di letter carry di title, “Mobilisation for Peaceful Procession and Prayer Session in Solidarity.”
Di police don invite Joe Ajaero, di president of NLC, make e come answer question about allegations wey concern “criminal conspiracy, terrorism financing, treasonable felony, subversion, and cybercrime.”
According to Ugboaja, di procession na because of di recent call wey di police give Ajaero to appear for questioning in August on top wetin dem call false accusations.
“We dey call on all NLC affiliates and state councils make dem mobilise dia members for Abuja and across di states to show solidarity.
“All Central Working Committee members wey dey reside for Abuja and other members, make dem gather for di National Headquarters of NLC by 8:00 am on August 29.
“Dis na to follow di President go Police for di scheduled interaction,” e talk.
E advise people wey dey state capitals to gather for di state secretariats of Congress. E also talk make dem do peaceful procession go dia State Police Headquarters to hold prayer session until di President finish im meeting with di Police.
“Dis peaceful march na united stand against di unjust actions wey dem dey use intimidate our leadership and try silence di voice of Nigerian workers.
“We dey urge all members make dem remain peaceful and orderly throughout di procession and prayer session.
“If for any reason, dem detain di President; all workers nationwide go enter indefinite strike.
“Your strong support and solidarity for dis critical time dey very important to defend Civic rights and di integrity and rights of di labour movement.
“Together, we go overcome these challenges and continue to uphold justice, fairness, and democracy for our dear nation,” e add.