Nigerian goment react to attack on citizens for India university

October 18, 2022

Nigeria goment say Indian Authorities don agree for one written commitment to protect Nigerian students for dia.

Abike Dabiri-Erewa, oga for Nigerians in Diaspora Commission (NIDCOM), tok dis one as she dey react to di news wey report say dem attack Nigerian students for one India university.

On Monday, one viral video show as kasala gas for one University campus inside Delhi.

Na one Professor of Peace and Conflict Research, Ashok Swain bin share di video for twitter and write say;

“Dem dey attack Nigerian students for one University Campus near Delhi – 30,000 Nigerian students come to study for India paying money, 50,000 Indians live in Nigeria to make money. “