Oga pata-pata of di Nigerian police don announce say dem go deploy over 400,000 security personnel for di forthcoming 2023 general elections to ensure smooth conduct of di exercise.
Di Inspector General of Police, Usman Alkali-Baba give dis informate as e dey brief tori pipo for State House Abuja on Thursday.
Im briefing na on di level of preparedness of di police for di 25 February and 11 March elections, say dem don put in place operational and tactical measures to ensure say di elections take place.
E say police go deploy “310, 973 personnel wey comprise of conventional policemen, mobile police, special counter-terrorism-unit, special forces, intelligence response team plus oda sections of di police for di election, while di oda security agencies go deploy 93, 495 personnel for di 176, 846 polling units, 8,809 wards and local goments across di federation.
“From Inec records, na 176,846 polling units dey exist for di 8,809 wards for di 36 states plus di federal capital territory, wia dem go conduct elections,” e tok.
Di IGP say “Di Nigeria police, wit support from oda security agencies, don perfect plans to deploy in a coordinated and collaborated manner to cover all locations.
“Di deployment go cover di national collation centre for Abuja as well as oda collation centres across di states of di federation, FCT, and 774 LGAs,” Usman Alkali tok.