Dem don name Argentina and Paris St-Germain forward Lionel Messi men’s player of di year for di 2022 Best Fifa Awards.
Di 35-year-old beat French forwards Kylian Mbappe and Karim Benzema to win di prize
Messi bin captain Argentina to World Cup glory for Qatar, and e score 27 goals for 49 games for club and country for 2021-22.
Dem name Barcelona Alexia Putellas women’s player of di year.
Messi, wey win di award for di second time, say: “E dey amazing. Na honour for me to dey here and to win dis award. Without my team-mates I no go dey here.
“I achieve di dream wey I don dey hope for for so long. Na very few pipo fit achieve am and na luck I get to do so.”
For di ceremony for Paris, dem name Lionel Scaloni, wey lead Argentina to dia third World Cup title, men’s coach of di year.
Scaloni beat Pep Guardiola – wey guide Manchester City go di sixth Premier League title – and Real Madrid Champions League-winning boss Carlo Ancelotti to di honour.