Dem say the film dey misrepresent the culture of Lagos State.
For statement on Wednesday, April 12, wey the state Commissioner for Tourism, Arts and Culture, Uzamat Akinbile-Yussuf, condemn the film for misrepresenting the culture of the state.
She hama the producers for the way wey dem show the Eyo masquerade as masquerade wey dey carry gun.
Di movie na crime thriller wey try reveal how life be for Isale Eko, one of di popular areas of Lagos.
Di movie dey enjoy plenty reviews as pipo dey react to di different parts wey make up di feem.
But di movie wey just come out about a week a ago don begin cause controversy especially among traditionalists and stakeholders.
Na why di Lagos state goment don chook mouth put for di matter.