Nigerian striker Victor Boniface don talk say e dey disappointed say dem no include am for di shortlist for Confederation of African Football (CAF) Men’s Player of the Year award. For one video wey sports journalist Pooja post on Sunday for X, Boniface, wey get better 2023/2024 season, tok say, “Not sad, but disappointed because I had an amazing season last season, so for me not to be there… maybe the award is for African players in AFCON, I don’t know. But in general, if it’s for African Player of the Year, I think I had a great season.”
Boniface also yarn say e no dey put awards for priority, but e still dey focus to improve him game. “I don’t need to prove to anybody; I don’t really care about awards and stuff. But of course, as a football player, I want to improve, I want to do more for myself,” e add.
When dem ask am who e feel suppose win di award, Boniface call Ademola Lookman name, talk say, “Lookman, for sure Lookman.” Di CAF shortlist wey dem announce for October get Nigerian players like Ademola Lookman and William Troost-Ekong, but e no include Boniface and di current titleholder Victor Osimhen. Other players wey dey di list na Morocco’s Achraf Hakimi and Sofiane Rahimi, Algeria’s Amine Gouiri, Ivory Coast’s Simon Adingra, DR Congo’s Chancel Mbemba, Guinea’s Serhou Guirassy, Burkina Faso’s Edmond Tapsoba, and South Africa’s Ronwen Williams.