For one recent interview wey Adesope Olajide, di presenter of di Afrobeats Podcast, do, dem ask am about im own thoughts on di unresolved issues between am and im brother.
Adesope ask am, “Wetin we dey see publicly na say ‘Oh, di duo don separate and dem no fit settle,’ but as human being for your quiet moments, how you dey feel say una no fit work things out?”
Rudeboy come express im frustration, saying e no go like talk about di matter again to avoid make dem no twist im words.
He tok say, “I go talk something, and I dey sorry. I sabi say na show, but I no wan talk anything. I don tire for this twisting of statements; you be P-Square fan, and na my family matter. So why I go talk something now wey go turn to another thing? Make we just focus on Rudeboy.”
Dis one dey come after Paul reveal say on August 1, 2024, di P-Square duo don break up again. Paul still tok say Peter carry di matter go EFCC, invite am and dia elder brother, Jude Okoye. Paul add for di interview say di EFCC investigate di claims of financial misappropriation but dem no find anything.
Later, Peter reply for open letter, tok say di interview wey Paul do don damage di history wey dem share and also im individual contribution to di group. E make am clear say he and im twin no dey in any competition.
Nigerians both home and abroad don react to dia public quarrel, and politician Peter Obi even personally visit di brothers to try reconcile dem.