‘’I bin dey Hawk for Street but na I be Treasure for Africa’’ – Osimhen Tok

December 13, 2023

CAF Best African Player for 2023 Victor Osimhen don tok say na evriday of di week im bin dey hawk wen e dey grow up but now im don grow to become treasure for Africa and world football.

E also add say losing im parent leave scar for im hearts as dem always be driving force for im success since im be small pikin.

Osimhen tank Nigerians for dia support even wen di critics, hate and pain of defeats dey hit am hard for chest.

“I know say my parents dey smile at me for heaven,” e tok