How Japan beat Germany for di first time in history

November 23, 2022

Japan don sama Germany 2-0 for di 2022 World Cup for Qatar. Both teams wey dey for Group E meet each oda for Khalifa International Stadium.

Dis na di first time wey Japan go beat Germany for World Cup, and dis one mean say na historic victory for di Asian kontri.

Na four times Germany don win di World Cup (as both Germany and West Germany).

Dem don also be runners-up four times. Germany don also win di European Championship three times and dem don also be runners-up three times.

Dem bin head to Qatar to prove a point afta dem finish bottom of dia group for Russia four years ago – dat na dia earliest World Cup exit in more dan 80 years – before dem lose to England in di last-16 for Euro 2020. But dis point wey dem wan prove turn anoda tin for di hand of Japan.

Di 2022 World Cup na Japan seventh consecutive World Cup appearance and dem don reach di last-16 three times, including wen dem co-host di tournament for 2002.