GOVNOR WIKE DON INAUGURATE FIRST BATCH OF IM SPECIAL ASSISTANT

November 4, 2022

Even as public still dey criticize, Rivers State govnor Nyesom Wike don inaugurate di first batch of im 100,000 Special Assistant ontop Political Unit Affairs.

Di event bin happen yesterday for di Adokiye Amiesimaka Stadium, even people from di Rivers West and Rivers South East Senatorial district of di State, di govnor follow commission dem.

As people bin dey congratulate dem say dem make di list to serve as aides to di govnor, Wike come tell dem to put their self inside di shoes of di people for their Political Unit wey concern Programmes and Policies of im administration.

Di Special Assistants to di govnor on top Political Unit Affairs, dem expect dem to do well and also send feedback through di 319 ward and 32 Constituency Laison Officer wey dem just appoint, den dis Laison Officers go come send am go di govnor’s office.

Di second batch of Special Assistants to di Govnor on Political Unit Affairs from di Rivers East Senatorial District, tori talk say dem go inaugurate dem today for di same venue by 11am.