Google reveal di pipo and tins Nigerians search for di most in 2022

December 8, 2022

Google don release di list of di tins wey pipo search for pass for di year 2022 and presidential candidate of Labour Party (LP) Peter Obi, Iphone 14, Nigerian musicians Oxlade and Asake make di list.

Under searches category, na Afcon top di list, while Asuu strike follow. Oxlade na im carri first for pipo category, while Will Smith top di list for actors category.

Asuu strike dey di list sake of say di Academic Staff Union of Universities bin down dia tools to press home dia demands to di Nigerian goment for eight months.

Talented artiste Oxlade make di list sake of im leaked sex tape wey bin trend for February dis year.

Peter Obi, di Labour Party presidential candidate make di list sake of im Obidient movement both online and offline.

Will Smith top di list of di most searched actors sake of di slap wey im give comedian Chris Rock during di 94th Academy Awards aka Oscar for March dis year.

Yul Edochie make di search sake of say im announce im second wife Judy Austin and dia son for April.

See some of di categories and how pipo search.

Searches

1. AFCON

2. ASUU Strike

3. IPhone 14

4. Oxlade

5. NATO

6. Buga

7. Peter Obi

8. Ukraine

9. World Cup

10. Asake

People

1. Oxlade

2. Peter Obi

3. Asake

4. Black Sheriff

5. Casemiro